Monday, February 26, 2007

Waffarian's weekend.

Okay, my people, make i tell una wetin I do for weekeend. I carry myself go the "country" or as my waffy sister dey call am "oyibo village". Anyway, I decided to participate in some winter activities this one wey be say the snow no wan end for my area. Na so oh! I dress myself well well, I enter my new snow scooter (okay.....no be my own, na oga aproko buy am,ehnnnnn, no be new one, na second hand, but the whole thing na my idea sha), anyway, na so i begin dey ride up and down for the ice(those of una wey no understand, wey temperature drop below 0, the surfaces of the sea, lakes etc freezes and if more snow falls, that melts and in its turn freezes and so on and so forth, anyway, one can go for all sorts of winter sports like ice skating, skiing, etc), infact, i even dey go the other side of the ice wey nobody dey self. Waffarian just dey enjoy herself.Na so oh, I come see two men come with one kind "drilling" machine, I carry my aproko self go ask wharrishappening, dem say dem dey measure the ice to check if it is safe for them to drive their scooters. I come begin laugh, I say okay, I ride commot. After a while, one of the guys came back with his snow scooter, drove for about 10 meters and went back on land. I come go there again, wetin dey happen? Bobo talk say im no trust the ice, e no sure say e go fit hold the weight of the scooter. I say WHAT? but me, i don go back and forth now, nothing don happen, dem say dem advise me to comot for the ice. Anyway, fear catch me, i come ask oga aproko why im no tell me say the ice no dey safe? im say the ice na "borderline". Ehhn? wetin dat one mean? oga say ehn now, say no be perfect condition, but make i no worry, make i dey drive. HISSSSSSSSSSSSSSSSSSSSSSSSSSS ,dem no tell me twice before i go for land, anyway, i carry the machine go forest, chei! the thing hard oh! after i don nearly jam all the trees, i park the thing. E no sweet me anymore. I come decide to call my bros for Warri, the bobo vex me, e begin dey laugh me, say, i no know say certain sports na for oyibo people? anyway, na my weekend be dat. Next weekend, i dey go again, na me and those trees!

14 comments:

4wardnfiaca said...

ol gurl, na u o. u jus dey haf fun. i no 2 blame u, na like so me sef be. i go soon update dv stori as soon as i com down from my high

LondonBuki said...

LOL!!! It's true sha... what were you doing with a snow scooter? You won't find me near nonsense like that and skiing? No way!

UnNaked Soul said...

LOL!!! e be like say the weather dey affect you. wetin concern u concern oyibo okada? you well so?

Ubong Da said...

I agree with your bros o! You don see where black man climb mount everest or jump off mountain. We never chop finish here na oyibo madness we wan carry. Abeg no go o! before you fall peme inside ice water. The water cold pass Abraka resort where u dey go swimming o! I beg u

Unknown said...

waffy you did what? snow scooter keh? u mean say you take money buy that machine? na wa oh... lol

Confused Naija Girl said...

Lmao wffy girl! your eyes have become to big for your stomach, those kind yamayama sports na for oyinbos now!!

Bubbles said...

At least u don try the thing. Nothing wrong with new experiences.

kramer said...

Very funny, na true talk dem dey talk. Winter sports no concern African man. But it sounds like good fun sha. Pls take it easy!

iconoclastic said...

i feel ur determination na in me 2 i dey use 4 other stuvs.. aliyah talk say if u dont sucees brace urself up n try again.. so goodi luck oh wiv d trees

Omodudu said...

My fren I hope ya have life insurance o. Thanks for coming by.

Omodudu said...

Added to my reader.

gypsygirl said...

yeah yeah yeah...whatever! because we no get scooter or even snow sef for this yeye london u won do us jealousy,anyway good for u have fun.call u later! take care.

AbujaBabe said...

MADDD FUN!!!!

laspapi said...

"im say the ice na "borderline". Ehhn? wetin dat one mean? oga say ehn now, say no be perfect condition, but make i no worry, make i dey drive."-

I read dis t'ing begin laugh, waffy. you for don become ice cube now. na your scooter for be d ice-tray.